Presidential Election Tribunal reject PDP request to inspect INEC server

Di Nigeria Presidential Election Petitions Tribunal don reject di request of di main opposition People’s Democratic (PDP) to get access to di server of di Independent National Electoral Commission.

Di five members of di panel strong mouth no gree di request of di PDP and dia candidate Atiku Abubakar becos of oda issues wey don join di case, wey concern dis server mata.

Di judges say di tribunal no fit enta di mata of weda or not INEC use server transmit results at dis stage.

Advertisement

Atiku no be Nigerian – APC
Head of Nigeria Presidential Election Tribunal don step down
Buhari neva forget say Abuja no vote am for 2019 election
For dia ruling, di tribunal say INEC don deny say dem get any server and say dem no use any electronic means take send result go any server as di petitioners dey claim. Dem say to grant dia request go mean say dem don begin enta di main issue at dis stage.

“E no go make sense,” Justice Garba wey read dia ruling tok.

Im say if di court gree PDP request, e go mean say dem don “recognise and find out say central server dey wia all di results of di 23 February 2019 enta.”

Add a comment

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *

Keep Up to Date with the Most Important News

By pressing the Subscribe button, you confirm that you have read and are agreeing to our Privacy Policy and Terms of Use
Advertisement